Connect with us

Meghan Markle: Why Prince Harry’s Child Is Not A Prince!

Foreign

Meghan Markle: Why Prince Harry’s Child Is Not A Prince!

Source: bbc.com

THIS IS PIGGIN ENGLISH

For di interview she do with Oprah Winfrey, Meghan Duchess of Sussex tok say wen she get Archie belle, dem bin dey tok about di pikin future, which title im go get.

She tok say, “dem bin dey say dem bin no want di pikin to be prince or princess.

Dis na even before dem even sabi di pikin gender, wey bin dey different from protocol.”

Read Also: Prince Harry and Meghan fire UK staff, close Buckingham Palace office

Wetin royal protocol tok?

Di rule about who fit collect title of prince and who dem fit call ‘His royal highness’ (HRH) dey letter patent wey King George V write for November 1917.

Letter patent be like legal instrument from di monarch wey dey come as open letter and dem dey use for royal declarations.

Di letter patent for 1917, George V tok say di great-grandchildren of di monarch no go collect Prince and Princess except for di eldest son of di eldest son of di Prince of Wales.

So wetin dat one mean be say Prince George go be Prince but not Archie or im cousins Charlotte and Louis.

However, Charlotte and Louis keep dia title on top letter patent wey Queen Elizabeth release for 2012 say make all Prince Williams pikin dem be prince and princess and fit keep di HRH title.

What about Archie’s title?

According to di 1917 letter, Archie fit still become prince but not yet.

Di Duke and Duchess pikin dem go need to wait until Prince Charles become king, so dem go become grandchildren of di monarch and na den dem go collect dia prince and princess title.

Na why prince Andrew daughters, Beatrice and Eugenie na princesses from birth but Eugenie son no be prince.

And di Duchess sabi dis protocol, as she tok about am for di interview say, her pikin go become prince “wen Harry papa become king”.

However she ass say dem tell her wen sje get belle say “dem wan change di convention for Archie” so e no go be prince.

She no took more about di mata and Buckingham Palace neva tok fem ontop her claims.

Continue Reading
Advertisement

As someone who loves writing, I decided to explore my passion by being a freelance writer. One of my many favorite quotes is : Either write something worth reading or do something worth writing. - Benjamin Franklin

More in Foreign

VIDEO OF THE WEEK 👇

👉 Breaking News 👈

Trending News

SHOP @ JEANIE JQ

Popular Tags

To Top
Verified by MonsterInsights